Navigation menu

Sunday, November 18, 2012

Paul Wife Commot Belle since Nine Years Ago And She No Gree Tell am!

-->
here people, how una dey na?
i twale for una o... happy sunday evening oh!  my name na ikpaiju and today i wan ask una sometin...
one man call me for my show today... he bin dey vex well-well about how e marriage don spoil finish as we dey talk so...
he say, him wife wey e marry for 9years bin dey hide from am, the truth about the condition of her womb.. the man wey him name na Paul Ezekwe talk say, e wife been do abortion wey bin wan take her life and the doctor advise her say, for her to stay alive, she go get remove her womb oh..