Paul Wife Commot Belle since Nine Years Ago And She No Gree Tell am!

Sunday, November 18, 2012
-->
here people, how una dey na?
i twale for una o... happy sunday evening oh!  my name na ikpaiju and today i wan ask una sometin...
one man call me for my show today... he bin dey vex well-well about how e marriage don spoil finish as we dey talk so...
he say, him wife wey e marry for 9years bin dey hide from am, the truth about the condition of her womb.. the man wey him name na Paul Ezekwe talk say, e wife been do abortion wey bin wan take her life and the doctor advise her say, for her to stay alive, she go get remove her womb oh..
Na so the tori take start: before she jam her husband, she been dey pregnant for her former boyfriend and you know the levels wey girls of nowadays dey operate when pikin enter by mistake na???, 
so she wan been go comot the belle when doctor tell her say she get fibriod, by that time, doctor don put instrument for her "kpekus", only to find out sey, the chic come dey bleed like tap. na so the doctor just commot her womb, make she for no die...
The matter be say, years after wey she come marry another man, wey be Paul  so, she no gree open mouth tell this her husband before marriage sef, say 
"i don commot my belle ohh, you go still fit marry me???", so that the man go know wetin dey, whether to marry fellow man as e be so because of love or to jus find e level...
Nai this woman stay tey oooo till nine years pass, this her husband no dey see any sign of pregnancy!!! 
As water don dey pass garri so, paul no fit come wait again, nai he vex carry him wife go hospital for check up and scanning.
 The woman wey hin dey waste e sperm for so na, no even get womb to take carry pikin and she know all the koko all the while but she keep quiet!!!
as we dey yan so, the husband to this woman dey para, no be small tin
abeg, wetin you go fit advise the man to do?
you want make e forgive the wife, leave her for hin house, still marry am or make e jus marry another woman, then kick the wife commot?
 

0 comments:

Post a Comment

Powered by Blogger.
Back to Top